Skip to content
Scan a barcode
Scan
Paperback Abuja Na Kpangba and Other Poems in Naija Pidgin Book

ISBN: 9789122675

ISBN13: 9789789122677

Abuja Na Kpangba and Other Poems in Naija Pidgin

Abuja Na Kpangba and other poems na di first collection of poems for Pidgin wey anybody go write since 1982 wen Frank Aig-Imoukhuede first publish im poetry book for pidgin wey dem dey call Pidgin Stew and Sufferhead. Di first time Oribhabor bin publish dis poems na for Naija languej spelling system wey Naija langwej Akademi (NLA) bin dey try to put together. But as the spelling no work well, dis edition of dis book na for Naija Pidgin wey everybody go fit connect with easily. Dis book of poems na major work because, e contain fifty one diffren poems wey concern we all for Nigeria.

For dis book, Oribhabor give powerful message about how Nigeria and im pipul dey waka. Di poems carry diffren level of how things dey happen since dem born am for im country. Since pikin no fit tok sey im mama no be im mama again, sek of sey e worwor, na so Oribhabor dey want mek we know Naija Pidgin and see ourselves as ambassadors of di language. E want mek we know sey, as life get sweet part for Naija, na so e get tough part. E want mek we feel di wey Naija pipul heart dey beat and di kind of change wey dey happen everyday.

Whether you tall or shot, whether you fat or slim, whether you get money or no get money, dis book na for everybody. You go learn plenty lesson and get suplus sense on how to tek succeed for Naija. Na everybody book for everybody.

Divid Esizimetor
Benin-City, Nigeria
October, 2009

Recommended

Format: Paperback

Condition: New

$13.97
Ships within 2-3 days
Save to List

Related Subjects

Poetry

Customer Reviews

0 rating
Copyright © 2026 Thriftbooks.com Terms of Use | Privacy Policy | Do Not Sell/Share My Personal Information | Cookie Policy | Cookie Preferences | Accessibility Statement
ThriftBooks® and the ThriftBooks® logo are registered trademarks of Thrift Books Global, LLC
GoDaddy Verified and Secured